Dreaming of what is in view.
I dream say
One day, one day, e go beta
No mata wetin dey happen today
No chop, no cloth
No good road, no house
Nothin
Every day na so so wahala
Wahala for house
Wahala for road
Even Boko Haram sef come add join am
Boko Haram don turn bomb to christmas knock out
Ma pipo
Dey fear to commot for house now
Sake of say dem fit die for dem hand
Life don cheap well, well for naija
It is now three for one penny
But I dream
Say one day, one day
Life go beta.
Currently there are no comments related to "Dreams". You have a special honor to be the first commenter. Thanks!
Welcome to Authspot, the spot for creative writing.
Read some stories and poems, and be sure to subscribe to our feed!